BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei wey dey power for over 30 years die for US-Israeli strikes
US President Donald Trump confam di death of Iran supreme leader, Ayatollah Ali Khamenei for im social media account.
Iran strike on Dubai and Abu Dhabi airport for Middle East kill one pesin and injure odas
Falling remains from intercepted Iranian drones and missiles cause widespread damage across di Gulf.
Why US and Israel attack Iran, how Tehran respond and wetin go hapun next?
Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei don die afta Israel and di US launch one "massive" and ongoing attack against Iran leadership and military. Dis na wetin we know about di attack.
State police: Wetin e go take to reorganise police for Nigeria?
Di latest of di recent calls for di decentralisation of Nigeria policing structure na from President Bola Ahmed Tinubu wey appeal to di National Assembly to amend di constitution to 'provide legal framework for di establishment of State Police to tackle insecurity nationwide.'
EFCC drag Malami, im wife and son go court again as new judge cancel former bail
Justice Joyce Abdulmalik of di Federal High Court of Abuja, na di third judge wey dey handle di case now.
'I no see anytin, I no do anytin wrong,' Bill Clinton testify about link wit Jeffrey Epstein
Bill Clinton meet wit di committee behind close doors to tok about im connection to Jeffrey Epstein for Chappaqua inside New York on Friday.
Wetin you need to know about di Inec revised 2027 election timetable
Inec also review timeline for oda 2027 election processes.
Pakistan strike Afghanistan, PM say dem dey 'open war'
Pakistan bomb Taliban govment targets for Afghanistan big cities overnight, officials from both kontris tok on Friday, and Pakistan defence minister call di conflict "open war".
Ginger Me
Special Tori
'Nobody fit bully me' - Seyi Tinubu react to social media influencer King Mitchy controversy
President Bola Tinubu son, Seyi Tinubu, don react to di allegations wey link am to di gbasgbos between social media influencers VDM and King Mitchy.
Epstein try to buy one palace for Morocco days bifor im arrest for 2019
Di disgraced financier bin dey for discussion to buy di luxury palace Bin Ennakhi - but di purchase bin no dey completed.
How Nigerian singer Simi enter controversy sake of her Tweets
Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency say dem dey chook eye for one controversy wey involve Nigerian musician Simi.
'Imo State 'Tiger Base' police station na base of extrajudicial killing, torture, extortion' - Amnesty International claim
Global human rights body Amnesty International say dia investigation show say di Owerri, Imo State based police unit don commit plenty human rights violations.
Kontries affected by UK new travel rules for visitors
From 25 February, a new system go take effect and pipo wey e go affect, include British dual nationals.
Ejections, shouting and hockey players: Key moments from Trump big speech
Di speech come for a particularly pivotal time, as tensions dey fly sake of Iran and Trump global tariffs wey court throw way.
Peter Akpe take oath of office as Deputy govnor of Bayelsa state
Dr Peter Akpe dey come as Deputy Govnor of Bayelsa State after di death of former deputy Govnor, Sen Lawrence Ewhrujakpor wey die in 11 December, 2026
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.











































